Blog Archives

Norwich 1 Arsenal 2: Oga van Persie, you get mouth

I know say my oga @HexyDre dun give una give una the ogbonge match report unto this match but I wan give una my own season two.

Omo mehn, no be small tin. Oga van Persie just dey show imsef this year and I been dun carry am for mind say im go knack Norwich akpako. Prof. Wenger boys dun dey use their head ni, and them been dun win four league games straight up before them knock this match.

Jenkinson go wounjure imsef, so Prof tell Koscielny baba, make im go man two today. Every other person whey been play for that 3-0 knacking of West Brom fully ground gidigbam. As una dun see, I dey write this post for Pidgin so if you no like am, that wan na for your pocket, your pocket……your pocket.

Na Arsenal start the match with high morale so that guy whey get okpon like Rita Dominic (wetin be im name sef………ehen Gervinho) come carry ball dey run before im give am to Walcott. Read the rest of this entry

Norwich vs. Arsenal: Match Report [Pidgin English]

O’ boy! Arsenal no go give person heart attack oh. At all at all na im bad sha, cos even Sound Sultan sef talk am ‘all way na way’. Yesoh, win na win any day – we go Caro road, we beat No-winchi and we commot 3 points for dem body like say we collect baba dudu for small pikin hand. Wetin else man dey ask for. Oshe!

The way wey we take start the game better pass how I been think say it go be, we no take much time to settle before we start to dey pepper their goal and nobody go blame you if you think say we go wire dem like 5-0 with our initial gra-gra. But the game come get k-leg wey be say our strikers just dey throwaway chance upon chance like semo wey don expire.

The people wey I predict say go start the game for Arsenal start, only be say Wenger use him experience over me come decide say Koscielny suppose play right back make Djourou take small time chill for bench. As game start, before one minute reach, Gervinho give Walcott pass but one no-winchi player block Theo shot. Van Persie sef get one chance after wey he balloon over the bar. Read the rest of this entry

Norwich Match Preview and Other WaZoBia Stuffs

Hello there and thanks for stopping by. This is my first post on WaZoBia Gooners and I will try to make the match preview as succinct as possible so I can get to mention other stuffs towards the end of the post.

The dreaded interlull has come and gone and all our players came back, uninjured, from international duties. We thank thee, o ye soccer gods! Ironically the players reported injured on the Arsenal website at the moment are those who didn’t travel for international football. Jenkinson has a stress fracture in his back and won’t be available for the trip to Carrow Road on Saturday, Gibbs just had a hernia surgery and will be out for between four and five weeks. The injury update page also showed Diaby and Chamakh are back in training, and Ryo is out for four to six weeks with a sprained ankle.

We have an early kickoff against the Canaries on Saturday; I don’t really know much about their players but for a newly promoted team they aren’t doing badly at all. They are just two positions below us on the league table, and having played 11 games they have a W-3, D-4, L-4 record. I watched the Read the rest of this entry